Monday 7 September 2020

Nigerian schools resumption date and private universities concerns as FG okay reopening of schools




Nigerian schools resumption date and private universities concerns as FG okay reopening of schools. Federal goment don okay reopening of schools across Nigeria.

Sani Aliyu of Nigeria Presidential Taskforce on Covid-19 announce for Abuja say make state goment dem plus school administrators dem make plans and prepare for di full reopening of schools for di kontri.

Some private universities for Nigeria don react to di announcement of di goment say make school dem prepare to resume

Di administrative staff of Afe Babalola University, Afeez Olaniyi, also say dem dey wait on specific pronouncemnt from di goment.



We dey more ready pass goment schools

Dr Owolabi also say must of di private university dey ready pass di state owned universities as dem do put in place measures to ensure say dia students dey safe wen dem resume school.




"Private universities dey ready pass goment universities wey I no think say dey really ready. I no fit speak for goment universities but private universities don dey ready to resume," Dr Owolabi tok.Before di announcements, some universities both private and goment don dey do online classes to complete di semesters inside di 2019/2020 academic calendar.



Latest update from Nigerian private universities

Achievers University, Owo -undergraduate admissions 2020/2021 session dey in progress.



Adeleke University -undergraduate admissions 2020/2021 session dey in progress - Dem add say make all students get certificate of medical fitness from home as dem return back to school, and di medical report suppose be within 24 to 48 hours s di time of resumption.



African University of Science and Technology (AUST) Abuja - Admission into 2021/22 Session start for July 2020



Ajayi Crowther University, Ibadan - second semester online examinations 2019/2020 - go hold Friday, 4 September, and Saturday, 5 September, 2020.



American University of Nigeria, start admission application for August, 2020.



Bells University of Technology, Otta just finish 2019/2020 Second Semester online examination.



Benson Idahosa University don start admission into 2021/22 Session.



Bingham University don start screening of fresh students into 2020/2021 academic session.

Chrisland University, Abeokuta conclude dia 2019/2020 second semester for August 2020 and don start screening of fresh students into 2020/2021 academic session.

Covenant University Otta, admission process into di University go continue on Monday, September 7, 2020, and dem go screen applicants wey wan enta di University. 

Di Covenant University Scholastic Aptitude Screening (CUSAS) na compulsory screening test wey di institution dey do for students. E dey always happun once a year before di beginning of di academic year. Dis year own go be online to obey di social distancing protocol wey dey on ground sake of Covid- 19.



Evangel University, Akaeze di Registrar John Nwagboso say di University go resume for revision and second semester examinations as soon as di National Universities Commission or di federal goment announce say schools fit reopen.



Godfrey Okoye University, Ugwuomu-Nike - Enugu State don start admission into 2020/21 Session.



Lead City University, Ibadan admission into di 2020/21 session dey open.



Madonna University, Okija First semester 2019/2020 examination for year one students go be online di same platform dem dey use for online lectures and di exam go start for 14 September and end on 22 September, 2020.



Oduduwa University, Ipetumodu - Osun State don start admission into 2021/21 academic Session, candidates wey wan change dia university of choice to dis one fit go di campus or visit any of dia screening centres.



Pan-Atlantic University, Lagos Undergraduate programmes - classes go begin for October, 2020.



Rhema University, Obeama-Asa - Rivers State don begin admission into 2021/21 academic Session.



Salem University, Lokoja don begin admission into 2021/21 academic Session.



Veritas University, Abuja don begin admission into 2021/21 academic Session.



Kola Daisi University Ibadan, Oyo State don begin admission into 2021/21 academic session.



Dominican University Ibadan Oyo State don begin admission into 2021/21 academic session.



Clifford University Owerrinta Abia State don begin admission into 2021/21 academic session.



Admiralty University, Ibusa Delta State don begin admission into 2021/21 academic session.



PAMO University of Medical Sciences, Port Harcourt don begin admission into 2021/21 academic session.



Skyline University, Kano don begin admission into 2021/21 academic session.



Trinity University Ogun State don begin admission into 2021/21 academic session.
Share:

0 blogger:

Post a Comment

Please drop your comments